something is singing inside.... the inner voices, the songs are singing inside

Saturday, April 16, 2011

Bring your Candle


E be like say I dey for darkroom
Without window
Without door
Eferiwhere jus dark patapata.
E be like say I get one hungiry
Wey chop no fit quench
De hungiry dey wire me
From morning reach night.

I sabi say darkness go quench
Wen you bring your candle
I sabi say hungiry go pafuka
Wen you bring your chop.
Bring your candle make we see together
Bring your chop make we chop bellewise.
Na only you fit killi de darkness
Na only you fit quench my hungiry.
Come now:
Na only you ! ! !

No comments:

Post a Comment