something is singing inside.... the inner voices, the songs are singing inside

Sunday, December 21, 2014

Allow me Rest

I run go north

East and west no where I no enta

And man scatter go south

Eferibodi dey ask say

wetin I dey fain.


I climb Kilimanjaro

I waka waka for Sahara

I enta ocean like fish

People thin say man

Wan run mental.


Wetin I dey fain?

I fain am for sleep

I fain am for chop

I fain am for work

Wetin I dey fain?


I no fit challenge Tyson

I no be Maradona

But dem nefer born de person

Wey go stop me from

De thin I dey fain.


Na immediate I see you

Na immediate I see you

My mind jus coole

like ocean breeze:


Make you allow me rest

I don see wetin I dey fain

Make you allow me rest

Becos na you I dey fain.


Friday, May 25, 2012

Too much Grammar


Oyinbo grammar na im dey cause palava,
Na grammar trouble we dey o,
Grammar don take-over;
Bifor you talk small thin for mouth,
Na so you go dey hear:
Rationalization, development plan,
Commercialization, conditionalities,

Na soso grammar, oyinbo too much.
Anytime we get big problem,
Na so dem dey scatter de grammar,
Make you lef de grammar o,
Whosai, dem no go gree:
Mobilization, Trade liberalization,
Restructuring nko?

Kai! Dem jus dey pepper de grammar,
But, e dey sweet dem for mouth sha,
Dis grammar sef, see how dem dey twist am:
Promissory notes, Privatisation, Debt rescheduling.

Na so dem dey run from de problem,
Problem come borku, grammar borku.
Dis grammar sef don dey block my ear o,
But man never belleful sha,
Grammar no fit belleful us o,

E blow all de grammar wey dey for dico finis,
Chineke! Dem just dey pieces de grammar,
Food too dey cost, grammar borku:
Dat one na consumer’s Resistance,
Abi na Buyer’s market?

Ba turanchi, na chop I wan chop.
pickins nefer go school
Oyinbo grammar don dey too much o!
Make we siddon tackle de problem,
Comot hand for de yeye grammar,
My broda, all de one wey you talk so
Nefer reach us o;
Remember say man must wack,
Grammar without action na one kain wahala.