something is singing inside.... the inner voices, the songs are singing inside

Tuesday, May 24, 2011

Make Dem Checkout

Dem dey speak through dem nose,
Dey talk like oyinbo,
Like person wey no dey shit :
“Hey men, how’re you doing”,
American slang dem sabi well well,
But wetin concern dem with de
Language of dem Papa?
Invite dem for parti,
Dem no dey chop African food,
If you no get spaghetti, salad,
Abi chicken and chips,
Dem no go chop.
Na only oyinbo sound dem go dance,
No play Fela, Sunny or Warrior o!
Just give dem de latest sound from US of A.
Even dem hair must resemble oyinbo own,
See dem as dem dey pose:
E dey wear dress wey im buy for London,
Shoe wey im get from Rome,
Shirt wey dem buy from Rome,
Shirt wey dem buy from Washington,
E don tay since we don independent,
Still some people dey, wey get
Oyinbo-made mentality,
De only advice wey I get for
Dose kain people be say :
Make dem checkout!

No comments:

Post a Comment