something is singing inside.... the inner voices, the songs are singing inside

Sunday, December 21, 2014

Allow me Rest

I run go north

East and west no where I no enta

And man scatter go south

Eferibodi dey ask say

wetin I dey fain.


I climb Kilimanjaro

I waka waka for Sahara

I enta ocean like fish

People thin say man

Wan run mental.


Wetin I dey fain?

I fain am for sleep

I fain am for chop

I fain am for work

Wetin I dey fain?


I no fit challenge Tyson

I no be Maradona

But dem nefer born de person

Wey go stop me from

De thin I dey fain.


Na immediate I see you

Na immediate I see you

My mind jus coole

like ocean breeze:


Make you allow me rest

I don see wetin I dey fain

Make you allow me rest

Becos na you I dey fain.


No comments:

Post a Comment