something is singing inside.... the inner voices, the songs are singing inside

Tuesday, January 25, 2011

Allow me Rest

I run go north
East and west no where I no enta
And man scatter go south
Eferibodi dey ask say wetin I dey fain.

I climb Kilimanjaro
I don waka  waka for Sahara
I enta ocean like fish
People think say man
Wan run mental.
Wetin I dey fain?
I fain am for sleep
I fain am for chop
I fain am for work
Wetin I dey fain?

I no fit challenge Tyson
I no be Maradona
But dem nefer born de person
Wey go stop me from
De thin I dey fain.
Na immediate I see you
Na immediate I see you
My mind jus coole like ocean breeze:
Make you allow me rest
Becos na you I dey fain.

No comments:

Post a Comment