For our place na good thin
Wen somebody get belle
But dis Africa belle
But dis Africa belle
Don overmature
Na real bad belle
Na wen e go deliver?
Soso famine and kwarshiokor borku
And beggar, beggar contri eferiwhere.
Long, long time after slavery
And efensef colonial master don comot
Still Africa no wan deliver.
Bifor, bifor wen Oyinbo come
Na some Africa man sell dem broda
Again, again dem dey hala for IMF and
Im cousin World Bank.
Dis time dem go blow grammar for UN and OAU
Becos dem be independent contri abi?
But my sista, na all of us sabi say
Na only flag we get:
Our maiguard dey combine with armu robber!
Africa get belle
E don overdue
Belle no wan comot
Na so Africa dey roll for ground
Becos de pain don pass mental:
Africa get belle
Na wen e go deliver?
No comments:
Post a Comment